Mr Chairman,
Accurate time keeper,
Impartial panel of judges,
My able Friends,
Fellow Co debaters
All protocols duly observed.
My name is my name, and I am here to propose the notion that states..
Niger state college of education Minna ( coeMinna got excited.
( ‘Nobody senior another person for this life, na turn by turn’, ) with my following reasons:
- 1. Dem first born you no mean say na you go first die. Even Bible support am.
- 2. If you first me touch ceiling because you tall, I go first you to pick stone for ground because i near ground pass you.
- 3. You fit first me enter SS1 and I fit first you enter university.
- 4. My jeep fit stop for road while your Beetle fit carry you reach house.
- 5. Girl wey marry last year fit born pikin before woman wey marry 10 years ago.
- 6. Small boy wey just finish school fit begin work before chairman wey do NYSC 2015
- 7. If aeroplane engine knock, both person wey dey first class and the one for economy, na the same Jesus dem go call.
- 8. Na Oga de pay driver, but AC de first blow driver before e reach oga for back.
- 9. Person wey de healthy fit die before person wey de sick.
- 10. You de stay upstairs no mean say you near God pass.
- 11. Stone de scatter water, and water de pieces stone.
- 12. When you see me na when I see you.
- 13.If you senior a guy no mean say you no fit date am, age na number.
- 14. Mr time keeper, as you want to ring that bell, may your time in this world not be over.
- 15.you go church everyday no mean say you better pass another person,calm down and do what is right because even Satan dey go church.
I hope with these few points of mine, I have been able to convince and not confuse you that ( ‘no body senior another person for this life. Life na turn by turn.)
Tags
Education